14 All di nashons bi like bird house for my hand and I gada dia propaty just as dem dey gada egg. Yes! No feada fit make mi fear and no bird fit open en mout sey e won bite mi!”
Dem vex skata and kill pipol for oda kountries and dem nor dey taya. Dem vex rule oda kountries as dem like kon dey opress di pipol and e nor taya dem.
Una own don finish! Una wey dey buy all di house and field join di ones wey una get, so dat pipol nor go get where dem go stay again. Naw, na only una go dey di land.
Una pride don deceive una. Nobody dey fear una as una tink. Una dey stay for rock and on-top mountin a nd even doh una house high like eagle own, God go bring una kom down.” Dis na wetin Oga God tok.