Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Isaya 1:6 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

6 From una head go rish una leg, na sore full am. Una body don skata, bikos sore full evriwhere and dem nor bandage, klean or trit dem at-all.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Isaya 1:6
20 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

E nor get pesin wey fine rish Absalom for Israel. From en head go rish leg, evriwhere dey okay.


God go kover where E for wound yu; na en hand wound yu and na dat same hand E go take heal yu.


Wen I dey trobol, I look for God. Thru-out di nite, I pray and lift my hand go heaven, but nor-tin fit konfort my soul.


Full moon lite go shine like sun for aftanoon and sun lite go shine seven times pass as e dey shine before and e go bi like seven days lite. Den God go join en pipol bones wey bin break kon heal all dia wound.


Na wikedness full human being mind and e bad well-well. Na who go fit undastand am?


God tell en pipol, “Dem nor go fit cure una wound and una sore go dey forever.


Make una nor komplain about una sore again, bikos e nor get cure. I dey ponish una like dis, bikos una wikedness and sin, too mush.


But I go heal di town and en pipol kon make dem well again. I go give dem peace forever and dem go dey save.


Dem dey trit my pipol wound like sey na ordinary tin. Dem sey, ‘Evritin go dey okay!’ Wen dem know sey nor bi so e bi.


Just as well dey bring fresh wota kom out, na so too Jerusalem dey bring all en wikedness kom out. I dey hear war and distroshon nois for di town kon si wound and sickness for evriwhere.


Yor sore nor get cure and nobody go fit heal yu again. Doz wey hear as dem take distroy yu, dey klap and sing with joy, bikos yor wahala and trobol, too mush.


But for una wey dey fear my name, my sun wey dey give life go shine and heal una. Una go dey free kon dey happy like melu pikin wey dem open en kage make e for go play.


Wen Jesus hear wetin dem dey tok, e kon ansa dem, “Pesin wey well nor nid doctor to cure am, but na who nor well, nid am.


E waka go meet di man kon rob wine and olive oil for en sore and bandage am. Den e put di man on-top en horse kon karry am go one hotel and e kare for am dat nite.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ