5 Israel pipol, wetin make una still wont make dem beat una? Una wont make dem ponish una pass dis ones? Sore don already full una head and una body don rotin finish.
Di king still send anoda offisa and fifty sojas go. Dis third offisa go meet Elijah kon fall for en front dey beg am, “Profet! Abeg, make yu nor kill mi and my men wey bi yor savants.
Una leaders don rijet mi and na tif bi dia friends; dem dey always kollect bribe from pipol. If pipol wey nor get papa and mama and doz wey dia husband don die bring dia kase kom meet una, una nor dey defend or listin to dem.
Even with all dis ponishment from God, Israel pipol nor gri turn from sin go meet di Pesin wey go save dem. Dem nor even tink to setol with di Oga God wey dey lead heaven sojas.
Manasseh pipol dey fight Efraim pipol, den dem join togeda go fight Judah pipol. And with all dis, God still dey vex and E dey ready to kill dem with en own hand.
Black man fit shange en skin kolour, abi leopard fit komot di mark wey dey en body? If dem nor fit, den e go hard for wiked pesin to do good, bikos na only to do bad tins, e sabi.
“Even as I ponish una shidren rish, dem nor gri shange or listin as I dey korrect dem. Just as lion dey kill en enemy, na so too una don kill una profets finish.”
Den all di men wey know sey dia wife dey offa sakrifice give oda gods and di wimen wey stand der with Israel pipol wey dey stay for Egypt sout, all of dem kon gada kom tell mi sey,
My God, shebi na trut Yu wont? But even wen Yu ponish dis pipol, dem still nor gri shange and wen Yu nearly distroy dem, dem nor gri take korreshon. Dia heart strong like rock and dem nor won turn from sin kom meet Yu make Yu for forgive dem.
Di profet dem dey lie; di priests dey rule as dem like and my pipol like am like dat. But di day wey wahala and distroshon go start, na where dem go run go for help?
I go-go meet and tok to di leaders, bikos dem know wetin God wont and wetin E sey make dem do.” But even dem too don rijet God and nor gri obey en kommand.
God sey, “Dis pipol bi like sojas wey don ready dia bows. Dem always dey ready to lie, bikos of dis, dem don get pawa for di land, but na wayo dem take get am. Dem don do many bad tins and dem nor dey tink of mi wey bi dia God.
Jerusalem pipol! Una yeye life don make una dirty, even doh I try make una dey klean, una still dirty. Una nor go dey klean again until my vexnashon don fall on-top una with full force.
“Doz wey don lost and wey waka anyhow, I go find and bring dem kom back. Doz wey get sore, I go bandage am for dem kon heal doz wey dey sick; but doz wey fat and strong, I go distroy dem, bikos I bi shepad wey dey do wetin dey rite.
Una nor gri kare for di ones wey dey weak; heal di ones wey dey sick; bandage di sore wey some get; go find di ones wey waka anyhow or look for di ones wey lost. Instead, una dey trit dem with wikedness.