Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Isaya 1:25 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

25 I go take akshon against una. I go make una dey pure like iron wey dem burn, den una go dey klean.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Isaya 1:25
18 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Yu swip wiked pipol komot dis world like dirty; know wonder I dey love to obey yor laws!


Jerusalem pipol, before-before, una bi like silva, but naw, una don dey yuzles. Una bi like good wine before, but naw, una bi like ordinary wota.


So like dis, God go forgive Jakob shidren and na like dat dem go take show sey dem nor go sin again. Dem go skata all di stone for dia juju altars kon distroy Asherah juju and all di incense altars.


God go use en pawa take judge and make di nashons holy. E go forgive Jerusalem pipol dia sins kon klean di land bikos of pipol wey dem kill for der.


Di judgement fire dey burn and e go distroy many yuzles tins. So e dey yuzles to dey try to klean my pipol, bikos wiked pipol still dey among dem.


Just as dem dey do one wiked tin finish, na so dem dey start anoda one. Dis pipol nor gri listin to mi wey bi God.”


So God wey dey rule evritin kon sey, “Like iron, na so too I go melt and test my pipol for fire, bikos dem don do wiked tins well-well. Abi na how I won do dem pass?


Doz wey bi sinnas, I go take dem komot from where una dey. I go take dem komot from di land where dem dey stay naw and dem nor go ever kom back to Israel land again. Den una go know sey na mi bi God wey get pawa.”


Mi God wey get pawa dey sey, dem dey yuzles like di yeye tin wey dey kom out from iron afta dem don melt am. So, I go gada all of dem kom Jerusalem.


Just as dem dey put silva, koppa, iron, lead and milk cup for fire wey go melt dem, na so too I go vex gada una put for hot fire.


Just as silva dey melt for fire, na so too dem go melt for Jerusalem, den dem go know and feel my vexnashon.”


For dat day, una nor go dey shame bikos of all una sturbones against mi. I go distroy doz wey dey boast among una and una nor go ever dey sturbon for my holy hill again.


E go kom judge like pesin wey dey wosh and klean silva and gold. Just as pesin wey dey wosh gold and silva so dat dem go klean, na so too, God messenja go wosh di priests, so dat dem go bring betta sakrifice kom give God.


Di fan wey e go take blow kanda komot from korn, dey en hand and e go gada and keep en korn inside store kon burn di dirty for faya wey nor dey kwensh.”


My pipol, make una happy, bikos God go fight for en savant; E go pay en enemies back kon sorry for en pipol and dia land.


I dey korrect and ponish anybody wey I love. So make yu dey sirious kon turn from sin kom meet God!


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ