For Mount Zion, God wey dey lead heaven sojas go do big party for all di pipol for di world. For di party, plenty food go dey to chop and wine go dey to drink; betta meat and sweet wine go dey too.
den una go si di joy wey go follow una as una dey serve mi. I go make dem honor una for di whole world and una go enjoy di land wey I give Jakob wey bi una grand-grand papa.” Na mi wey bi God tok all dis tins.
I dey tell una sey, doz wey woship and obey mi, go get plenty food to chop and drink, but food and wota go hongry una wey dey disobey mi. My pipol go dey happy, but na disgrace go follow doz wey dey disobey mi.
God still sey make I tell di pipol, “Make una listin! Mi wey bi God, dey give una shance to choose between dis two tins: ‘Di way wey dey lead to life or di one wey dey lead to deat.’
Oga wey bi Israel God wey dey rule all of us sey, Make una shange from di kind life wey una dey live kon do di rite tin. If una shange, I go allow una stay for dis land.’
Una harvest go plenty well-well, sotey una go still dey harvest korn until di time to pick grape and una go still dey pick grape for di time to plant korn. Una go get all wetin una won chop and una nor go fear for di land wey una dey stay.
So, Zerubabel wey bi Shealtiel pikin with Joshua, Jehozadak pikin wey bi di High Priest and evribody wey kom back from Babilon kon obey Oga God message wey E tell dem thru Profet Haggai and dem kon dey follow and obey God word, well-well.