Dia face dey show sey dem dey guilty. Just like di pipol for Sodom, na so too dem dey boast about dia sin. E bad well-well for dem, bikos dem dey distroy demsef.
Den make una remember God kommand and evritin wey di profets sey go happen. True-true, all di pipol wey dey si vishon, dey tok all dis tins, bikos dia mind dey dark.
But I si sey na Jerusalem profets own worse pass; dem dey sleep with who dem nor marry; dey lie; dey enkourage pipol to do bad tins, so dat dem nor go stop to live dia wiked life. To mi, all of dem bad and wiked like Sodom and Gomorrah pipol.
I go ponish Egypt, Judah, Edom, Ammon, Moab and di pipol for desert wey kut dia hair short for di temple. Even for Israel, nobody wey dem sekonsaiz, keep my kovenant for en heart.”
“Yor sista and en pikin dey karry body up, bikos dem get enough to chop and dem dey stay for peace, but dem nor gri kare for poor pipol and doz wey nor get to chop.
God sey, “Israel pipol, una dey important to mi pass Ethiopia pipol? Just as I bring Filistia pipol kom out from Krete and Siria pipol kom from Kir, na so too, I bring una kom out from Egypt.