For dat time, Menahem from Tirzah attack Tifsah. E kill evribody wey dey di town and doz wey dey stay near di town, bikos dem nor gri surenda. Even wimen wey get belle for der, e kut dia belle open.
Bikos deat don klimb pass awa windows. E don enter awa house wey dem guide well. E don kill awa shidren wey dey play for di street and di yong men wey dey di town centre.”
Just as dem dey invite pesin for party, na so too Yu invite my enemies and I kon dey fear. For di day wey God dey vex, nobody go fit eskape or survive am. Naw, my enemies don kill all di shidren wey I born and train.
di town wey dey near sea where dem for dey do business with pipol from difren place. Go tell dem wetin God wey get pawa dey tok: “Tyre pipol, una dey make mout sey una fine.
war go kom meet una and all una strong house go skata. Dat day go bi like wen King Shalman fight and distroy Bet-Arbel town kon kill both mama and dia shidren.
I go ponish Samaria pipol, bikos dem nor gri listin to mi. Dem go die for war; dia shidren go fall kon skata and dia wimen wey get belle, dem go tear dia belle open with swod.”
Efraim pipol go bi like plant wey en rut don dry and nor dey bear fruit again. Dem nor go get shidren and even if dem get, I go kill di ones wey dem like pass.”
Naw, Amazaya, God dey tell yu sey, “ ‘Yor wife go turn ashawo for di town and dem go kill yor shidren for war. Dem go divide yor land kon gi-am to oda pipol and yu yorsef go die for yor enemies kountry. Dem go must take Israel pipol from dia own land kon karry dem go anoda land as slave.’ ”