Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Hosea 9:11 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

11 Efraim greatness go fly komot like bird and dem nor go born shidren. Dia wimen nor go get belle at-all.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Hosea 9:11
18 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

E koll di sekond boy, Efraim bikos e sey, “True-true, for di land where I for dey sofa, God don make mi fruitful.”


Josef na betta vine wey dey produce good food; betta vine wey dem plant near wota and en branches dem dey klimb di wall.


Bikos of dis tin, Mikal wey bi Saul pikin, nor born any pikin till e die.


Wiked pipol lite go soon off; dia fire nor go ever burn again.


Make dem bi like snail wey dey die as dem dey waka! Make dem bi like pikin wey dem just born, wey nor ever si sun before e die!


If pesin get hundred shidren and e stay for dis life kon old, but if e nor get happiness and dem nor do betta beri for am, den I go sey, “Pikin wey dem just born and e die, betta pass am.”


Nobody or town go defend Israel land again and na oda pipol go rule Damaskus. Pipol wey go survive for Siria, dem go disgrace dem like Israel pipol. Mi, wey bi God wey get pawa, don tok.”


So, Samaria pipol go mourn for di juju wey Bet-Aven pipol. Dem go kry, bikos dem go take di juju from dem kon karry am go anoda land.


As di priests dey plenty, na so dia sin against mi, dey plenty too. So I go turn dia honor to disgrace.


Bikos Judgement Day dey kom wen dem go distroy Israel pipol. Wetin I dey tok naw, go really happen to una!


Oga God, na wetin I won sey make Yu do to dis pipol? Make dia wimen nor get belle at-all and nor let dem train dia own shidren!


God sey, “Ammon pipol don too sin, but I go ponish dem naw, bikos dem dey fight to get more land and wimen wey get belle for Gilead, dem tear dia belle open.


Bikos true-true, di time dey kom wen pipol go sey, ‘E good well-well for wimen wey nor born or feed pikin at-all!’


God go curse una shidren and una plants. E go still curse una animals and dia pikin wey dem go born.


and e go chop some since nor-tin dey to chop, bikos of di wahala and honga wey di enemies put una for una own town.


Josef get bull strent and wiked melu horn. E go rule pipol kon porshu dem rish di end for di eart. Dis na my blessing for Efraim and Manasseh pipol.”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ