9 Israel pipol sturbon like wiked donkey and dem don waka go dia own way. Dem don go meet Assyria pipol make e help dem kon pay oda nashons to protet dem.
Dis message na about di animals for Negev: For der, di pipol pak dia propaty and money on-top donkey kon travel pass one land wey wahala and trobol full; where lions, snake and oda wiked animals dey stay. Dem travel go meet pipol wey nor go fit help dem.
Una bi like wiked woman donkey wey grow for desert and bikos e dey find man, e go dey use en nose smell evriwhere weda e go si any one. Nobody fit hold am if e nid to sleep with man. Man donkey nor nid to go find am, bikos na en dey run follow dem.
Na breeze Efraim pipol dey chop. Dem dey porshu breeze from morning go rish nite. Dem dey gada lie and wahala kon enter agriment with Assyria and dey do business with Egypt pipol.
Wen Israel si as e dey sick and Judah si as e sore big rish, dem kon go meet Assyria great king make e kom help dem, but e nor fit cure or heal dia wound.
Efraim pipol dey waka up-and-down like bird wey dem dey kwik deceive; dem koll Egypt pipol make dem kom help dem fight; but afta, dem run go koll Assyria pipol too!