Wen Pekah dey rule Israel, King Tiglat-Pileser for Assyria kon attack and katch Ijon, Abel-Bet Maaka, Janoah, Kedesh, Hazor, Gilead and Galilee, plus all di aria for Naftali, den e karry di pipol go Assyria.
Dis one too na anoda sirious problem. Just as pesin take kom, na so too e go take go back. And dia hard work na for nor-tin, e just bi like wen yu dey try to katch breeze.
True-true, di day una start to plant, una dey do evritin wey una fit do, so dat di plant go grow. Di morning wey una start to klean di land, una dey do evritin wey una fit do to make di plant survive, but una nor go si anytin harvest and na only diziz and pain go follow una.
Why una dey spend una money for wetin nor go beleful una? Why una dey spend una money wen una know sey hongry go still kill una? Make una listin and do wetin I tok, den una go enjoy di best food.
My pipol go plant korn, but na grass dem go gada. Even doh dem work hard, nor-tin go show sey dem work, bikos I dey vex for dem, so dia food wey dem plant, nor go grow.”
Efraim pipol go bi like plant wey en rut don dry and nor dey bear fruit again. Dem nor go get shidren and even if dem get, I go kill di ones wey dem like pass.”
Oga God nor dey kwik vex, but en pawa dey great. E go must ponish wiked pipol. E dey show en great pawa thru strong breeze and heavy rain. Na di kloud bi di dust wey dey under en leg.
Una plant many korn, but wetin una harvest, small. Una get food to chop, but e nor dey beleful una. Una get wine to drink, but e nor dey rish una! Even wen una wear many klot, e nor dey make una warm and pipol wey dey work, dia salari nor dey rish dem spend.