Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Hosea 8:5 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

5 I hate di gold melu wey Samaria pipol dey woship. I dey vex well-well for dem. Na wen dem go stop to woship juju?

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Hosea 8:5
17 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

“Naw, yu won fight against di royal pawa wey God give David shidren-shidren. Yu fit get plenty sojas and yu karry gold juju as yor god.


Make Yu nor let mi do anytin wey nor good for yor eye and nor let sin kontrol mi. Den I go dey innocent and I nor go sin again.


Pipol wey nor get sense, na how long una won take bi fool? Na how long una won take wisdom do yeye? Una nor won learn at-all?


God sey, “Una wey survive for di nashons, make una gada kom! Pipol wey dey waka for evriwhere with di wood juju wey dem dey serve kon dey pray give oda gods wey nor fit save dem, nor know anytin at-all!


Jerusalem pipol! I don si as una dey do ashawo waka and as una dey run follow difren juju for fields and for evry hill. Naw, make una si di wahala wey dey wait una. So, una go ever dey klean to woship mi again?


“So Jerusalem pipol, make una from una heart stop all di bad-bad tins wey una dey do, so dat una go dey save. Wetin make una nor fit stop to tink bad-bad tins?


Den, just as Israel pipol shame for dia god for Bethel, na so too Moab pipol go shame for Kemosh wey bi dia god.


So, Samaria pipol go mourn for di juju wey Bet-Aven pipol. Dem go kry, bikos dem go take di juju from dem kon karry am go anoda land.


Dem go skata di juju house on-top di hill for Aven where Israel pipol for dey go woship am. Shuku-shuku and grass go grow kover dia altars. Di pipol go shaut koll di mountins sey, “Make yu kom hide us!” Dem go tell di hill, “Make yu kom kover us!”


Dem still dey sin and woship juju wey dem make kon design am with silva. Dem dey sey, “Make una kom sakrifice and kiss dis juju!”


Na una Israel pipol karve di juju by unasef. Di juju nor bi god! Di gold melu wey una dey woship for Samaria, go skata to pieces!


And doz wey swear with dat yuzles Samaria juju or with Dan juju name and vow with Beersheba juju, go fall for groun and dem nor go raiz-up again.”


I go skata all di image kon burn all dia juju propaty, bikos dem buy dem with ashawo money kon use dem pay ashawo for anoda place.”


So dem make image wey bi like melu, sakrifice gi-am kon bigin serve di melu wey dem take dia own hand make.


Bikos my vexnashon don kause fire and e don burn rish di part wey deep pass for di grave kon distroy di eart and en plants, den e skata di mountins foundashon.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ