2 Even doh dem sey I bi dia God and dey klaim sey dem bi my pipol wey know mi. But naw, Israel pipol dey beg mi sey, ‘Make Yu kom help us bikos Yu bi awa God!’
Una leaders nor dey judge well, bikos dem don take bribe and una priest dem dey do dia work, bikos of money. Una profets nor dey profesai unless dem first pay dem. Yet all of una sey una trust God. Una sey, “Nor-tin go happen to us, bikos God dey with us.”
If di Oga God wey get di house go lock di door, una go stand for outside dey nok and beg sey, ‘Oga God, make yu let us enter!’ “But e go ansa, ‘I nor know where una from kom.’
Dis kind pipol dey sey dem know God, but di way wey dem dey live dia life, show sey dem nor know am, bikos dem get bad mind, dey disobey God and dem nor ever dey like betta tin.