Na pipol wey nor dey faithful, full di land and dem dey live wiked life kon dey use dia pawa anyhow. Di pipol dey mourn and all di green leaf don dry, bikos God don curse dia land.”
I wish sey my head bi like well wey wota full and my eyes bi like fountain where wota for dey rush kom out, den I go kry well-well both day and nite for my pipol wey dem kill.
Even wen dem chop food, dem nor go beleful; dem go dey sleep with each oda, but dem nor go born pikin, bikos dem don turn from di Oga God kon dey follow oda gods.”
Dem dey ask wood make e show dem wetin go happen for future! Na stik dey tell dem wetin dem won know! Dem don leave mi. Dem bi like ashawo and dem don give diasef to oda gods.
Dem nor dey keep di promise wey dem make. Instead, dem dey lie, kill, tif and sleep with oda pipol husband and wife. Na so-so wiked tins dem dey do and dem dey kill each oda evriday.
Una wey dey do bad tins for dis world, una nor know sey to bi dis world friend, mean sey una bi God enemy? So anybody wey gri sey en and dis world na friend, don make ensef God enemy.