Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Hosea 7:3 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

3 Di pipol dey deceive di king and en ofisas with all dia evil plans and di prince dem dey make di king happy with dia lie-lie words.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Hosea 7:3
16 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Di ofisas wey go koll Mikaya kon tell am, “All di oda profets don profesai viktory give di king. So make yu do di same tin.”


So King Ahab koll almost 400 profets kon ask dem, “Make I go attack Ramot for Gilead or not?” Dem ansa, “Make yu go attack am, bikos God go make yu win.”


Wetin happen to yor profets wey sey Babilon king nor go attack yu or dis town?


Di profet dem dey lie; di priests dey rule as dem like and my pipol like am like dat. But di day wey wahala and distroshon go start, na where dem go run go for help?


I wish sey I get where I fit go stay for desert; I for go, so dat my pipol nor go fit si mi, bikos dem nor dey faithful to God.


But with evritin wey I tok, una plant wikedness kon harvest wetin una plant. Una don chop di fruit wey una lie-lie kause. Bikos una trust una shariot and di many sojas wey una get,


Israel pipol surround mi with lie-lie; na wayo full Efraim, but Judah pipol still trust and dey faithful to God wey dey holy.


Dem nor dey keep di promise wey dem make. Instead, dem dey lie, kill, tif and sleep with oda pipol husband and wife. Na so-so wiked tins dem dey do and dem dey kill each oda evriday.


Dem go opress and judge Israel pipol anyhow, bikos dem don make up dia mind to serve juju.


Wen di king dey do party, en and en ofisas dey drink well-well and dem go dey make plans with yeye pipol.


Una dey obey only King Omri wiked laws and una wiked like King Ahab! So, I go use una as ezample kon distroy una finish. Dem go ponish una and evribody wey si una, go laf well-well.”


Dia hand dey only like to do bad tins! Doz wey bi ofisas and judge, na only bribe dem wont. Doz wey get pawa, dey use am get wetin dem wont.


Aldo dem know sey God law sey, pipol wey dey live like dat go die, yet dem nor only dey do dis tins, but dem even dey support pipol wey dey do am.


Dem kom from dis world: so dem dey tink like pipol for di world and di pipol wey dey di world, dey listin to dem.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ