Wen di woman si sey di fruit wey di tree dey produce fine well-well and e good to chop; and e go make pesin get sense well-well, e kon take some of di fruit chop. Di woman still give some to en husband wey dey with am and e kon chop too.
Dem rijet en rules; di kovenant wey E make with dia grand-grand papa and di laws wey E sey make dem obey. Dem dey respet juju wey nor mean anytin and like dis, dem nor mean anytin to God again. Dem dey bihave like di kountries wey dey around kon make God dey shame for dem.
Pipol go dey sing for evriwhere for di world as dem dey praiz Israel pipol God wey dey raitious. But I nor get hope at-all and na die I dey die go so, bikos pipol wey dey lie, still dey lie and doz wey dey deceive odas, still dey deceive!
Una nor dey hear or undastand; na since dem born una, una ear block. Yes, I really know how una wiked and sturbon rish and na wiked pikin dem dey koll una since dem born una.
I tink sey afta dem do all dis tins finish, dem go kom back kom meet mi, but dem nor kom and dia sista Judah, wey nor dey faithful too, si wetin dem do.
E nor go bi like di old kovenant wey I make with dia grand-grand papa, wen I karry dem komot from Egypt. Even doh I bi like dia husband, dem nor gri keep di kovenant wey wi make.
I go ponish doz wey break di kovenant wey dem make with mi kon make dem bi like melu wey dem divide into two kon waka pass di centre. I go do am bikos dem nor gri keep di agriment wey dem make for my present.
From Adam kon rish Moses time, na deat dey rule for dis world, even doh nor bi evribody disobey God kommand like Adam. Dis Adam bi like Christ wey kom leta.
Bikos afta I don bring dem kom di land wey I promise dia grand-grand papa; di land wey get milk and honey; where dem go chop beleful kon get body, dem go turn go serve anoda god kon rijet and break my kovenant.
E nor go bi like di kovenant wey I make with dia grand-grand papa dem wen I take dem komot from Egypt, bikos dem break dat kovenant and I kon turn against dem.”