Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Hosea 6:10 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

10 I don si wiked tins for Israel: Judah pipol don make demsef dirty, bikos dem dey woship juju.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Hosea 6:10
14 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

King Rehoboam nor listin to dem, so e go ask di yong men wey bi en mate,


Dis tin happen, bikos Jeroboam make di Oga wey bi Israel God vex, with di sins wey en and Israel pipol kommit.


Dis tin happen, bikos Israel pipol sin against di Oga dia God; di Pesin wey save dem from Egypt pipol and King Fero hand. Dem dey woship oda gods;


God still sey, “Ask di oda nashon if dis kind tin don ever happen before. Israel pipol for bi like woman wey neva ever sleep with man wons, but dem don really do wiked tins.


But I si sey na Jerusalem profets own worse pass; dem dey sleep with who dem nor marry; dey lie; dey enkourage pipol to do bad tins, so dat dem nor go stop to live dia wiked life. To mi, all of dem bad and wiked like Sodom and Gomorrah pipol.


Wen King Josaya dey rule for Judah, God tell mi sey, “Israel pipol wey nor dey faithful, yu si all wetin dem dey do? Dem don waka leave mi kon dey do ashawo for under evry green tree and high hill.


Even doh e bi my wife, Oholah still dey do ashawo and e dey run follow Assyria sojas


Na Oholah all di ofisas for Assyria dey sleep with, so e kon dirty ensef as e dey woship Assyria juju.


God sey, “Bikos my pipol dey drink old and new wine, dem nor get sense again.


Dem dey ask wood make e show dem wetin go happen for future! Na stik dey tell dem wetin dem won know! Dem don leave mi. Dem bi like ashawo and dem don give diasef to oda gods.


Bikos of di juju wey Efraim pipol dey serve, curse dey dia head. So make una nor go near dem!


I know Israel pipol well-well; di wiked tins wey dem do, nor go fit hide from mi. Dem don turn ashawo kon make demsef dirty.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ