God don forget en pipol like lion wey waka komot for en kage go find food. Dia kountry don turn desert, bikos dem dey fear pipol wey dey opress dem and dem dey fear God vexnashon too.”
I go distroy all en vine and di fig tree wey e sey en lovers gi-am, bikos e dey serve dem. I go turn en gardins to wildaness; den wiked animals go distroy dem.
Doz wey remain for Israel go skata go oda nashons and dem go bi like lion among animals for bush; like yong lion wey dey mash and kill oda animals without who go save dem.
Dem go kill una melu for una own eye, but una nor go chop for inside. Dem go tif una donkey for una eye and dem nor go bring dem kom back. Dem go give all una sheep to una enemies and nobody go dey to save una.
God sey, “Na Mi, bi Mi! And e nor get any oda god escept Mi. I dey kill and give life, I dey make pesin sick and heal pesin too and nobody go fit fight mi.