Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Hosea 5:13 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

13 Wen Israel si as e dey sick and Judah si as e sore big rish, dem kon go meet Assyria great king make e kom help dem, but e nor fit cure or heal dia wound.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Hosea 5:13
16 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Assyria king, Pul kon attack di land and Menahem kon gi-am 1,000 silva, so dat di king go support and help am kontrol di kingdom.


Wen Pekah dey rule Israel, King Tiglat-Pileser for Assyria kon attack and katch Ijon, Abel-Bet Maaka, Janoah, Kedesh, Hazor, Gilead and Galilee, plus all di aria for Naftali, den e karry di pipol go Assyria.


King Ahaz send message go give King Tiglat-Pileser for Assyria sey, “I bi yor savant and I trust yu well-well. Abeg, make yu kom save mi from Siria and Israel king, bikos dem dey attack mi.”


But e go ansa, “Nor bi mi, I nor fit help una. I nor get any food or klot for my house, so make una nor make mi una leader!”


God tell en pipol, “Dem nor go fit cure una wound and una sore go dey forever.


Even doh e bi my wife, Oholah still dey do ashawo and e dey run follow Assyria sojas


Dem go give di juju as gift to Assyria king. Dem go disgrace and make Israel pipol shame, bikos dem go follow juju.


Na breeze Efraim pipol dey chop. Dem dey porshu breeze from morning go rish nite. Dem dey gada lie and wahala kon enter agriment with Assyria and dey do business with Egypt pipol.


Assyria pipol nor go fit save us and awa shariot nor go fit protet us. Wi nor go ever tell juju again sey, ‘Na yu bi awa god!’ Na Yu God dey save doz wey nor get papa and mama again.”


E go run follow en lovers, but e nor go fit katch dem. E go find dem, but e nor go si dem. Den e go sey, “I go-go back to my first husband. I betta well-well den wen I dey with am, pass as I dey naw.”


Efraim pipol dey waka up-and-down like bird wey dem dey kwik deceive; dem koll Egypt pipol make dem kom help dem fight; but afta, dem run go koll Assyria pipol too!


Israel pipol sturbon like wiked donkey and dem don waka go dia own way. Dem don go meet Assyria pipol make e help dem kon pay oda nashons to protet dem.


bikos my pipol sore too deep and e don even rish Judah too. Yes! E don rish Jerusalem gate.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ