Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Hosea 4:9 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

9 Dem go sofa di same ponishment with di pipol! I go ponish and make dem pay for di evil and wiked tin wey dem do.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Hosea 4:9
23 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Doz wey good, dey get dia reward for dis world, but na ponishment go follow pipol wey dey sin and do wiked tins.


Wise word get gain and hard work dey bring reward.


Wiked man sins na trap, bikos na en own sin net, go katch.


Evribody go sofa; priests and pipol; slaves and dia oga dem; pipol wey dey buy and sell; pipol wey dey borrow odas money and doz wey dey borrow from dem; plus rish and poor pipol: all of dem go sofa di same tin.


So make una tell innocent pipol sey e go betta for dem, bikos God go reward dem for wetin dem don do.


Di profet dem dey lie; di priests dey rule as dem like and my pipol like am like dat. But di day wey wahala and distroshon go start, na where dem go run go for help?


God tell mi, “I dey ponish Levi tribes wey join Israel pipol sin kon still woship juju.


But bikos dem follow odas go serve juju kon make Israel pipol sin, mi God wey get pawa dey swear sey I must ponish dem.


God tell Hosea, “Make yu koll am ‘Jezrel,’ bikos e nor go tey before I go ponish Israel king, bikos of di pipol wey dia grand-grand papa Jehu kill for Jezrel. I go skata Israel kingdom rish groun.


So, I go attack and ponish dis pipol wey dey sin. Difren kountry go gada against dem and I go ponish dem, bikos of dia sins.


Naw, God get wetin E go tok against Judah pipol. E go ponish Jakob shidren bikos of di way dem dey bihave. E go pay dem back for wetin dem don do.


Even for dia mama belle, Jakob struggol with en broda Esau and wen Jakob grow, e still struggol with God.


Dem nor know sey, I remember all di bad-bad tins wey dem do. Dia sin plenty well-well and I dey si all di wiked tins wey dem dey do.


Dem dey offa sakrifice give mi kon chop di sakrifice meat. But mi wey bi God nor dey happy with dem and naw, I go remember dia sin kon ponish dem. I go send dem go back to Egypt!


So God sey, “All di bad tins wey dem dey do, na Gilgal dem from start am and na from der I start to hate dem kom. I go drive dem komot from my land, bikos of di evil wey dem do. I nor go love dem again. Yes! Even dia leaders don go against mi.


Just as dem sin for Gibeah, na so too dia sin and wikedness dey bad rish. God go remember dia sin kon ponish dem.”


But evritin wey I tok thru my profets, happen to una grand-grand papa dem, just as I tok am. So dem turn from sin kom meet mi kon sey, ‘Oga God wey dey lead heaven sojas, na en really ponish us, just as wi deserve am. E don do wetin E sey E go do.’ ”


Make una leave dem! Dem bi blind pipol wey dey show blind pipol road. If pesin wey blind dey show anoda blind pesin road, two of dem go fall inside gutta.”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ