Even di profets and di priests dey stagga bikos dem don drink well-well. Dem don drink plenty wine and e dey konfuse dem. Dem don drink sotey dem nor dey fit undastand di vishon wey God send kom or judge any kase well.
Dem dey ask wood make e show dem wetin go happen for future! Na stik dey tell dem wetin dem won know! Dem don leave mi. Dem bi like ashawo and dem don give diasef to oda gods.
Efraim pipol dey waka up-and-down like bird wey dem dey kwik deceive; dem koll Egypt pipol make dem kom help dem fight; but afta, dem run go koll Assyria pipol too!
“Make yu and yor sons nor drink wine or strong drink wen una enter di tent, so dat una nor go die and dis na law wey yu and yor shidren-shidren must obey.
Wen Abigail go back go meet Nabal, e dey do party for en house like king. Nabal dey enjoy ensef and e don drink well-well. Abigail nor tok anytin until di next day.