Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Hosea 2:9 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

9 So for harvest time, I go take all my gifts wey bi korn, wine, wool and linen wey I gi-am make e wear.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Hosea 2:9
15 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Naw, I don raiz my hand won ponish yu kon take yor share for di blessing, komot yor hand. I don give yu to Filistia pipol; pipol wey hate yu and dem nor like di life wey yu dey live.


I go put yu for dia hand and dem go skata di place where yu for dey serve juju and do ashawo. Dem go take yor klot and gold go and yu go dey naked.


Dem go tear yor klot kon take all yor gold.


Siria king go-go back go gada many sojas wey plenty pass di first ones. Den for di rite time, e go attack with all en sojas wey dem don prepare well-well.


If e nor gri stop, I go naked am, just as e bi wen dem born am. I go make am bi like dry land, where nor-tin dey grow and I go let wota hongry am till e die.


Wen una plant breeze, una go harvest heavy rain. Una korn nor go produce bread. Even if e produce, na strenjas go chop am.


But very soon, una nor go get enough korn to chop and olive oil and wine nor go dey again.


Who know weda di Oga una God go shange en mind kon bless una with many-many food. Den una go offa korn and wine gi-am again.


So, pipol go tif and karry dia propaty kon skata dia house. Dem go build new house, but dem nor go ever stay inside. Dem go plant vineyard, but dem nor go ever drink from di wine.


Esau shidren-shidren wey bi Edom fit sey, “Even doh awa towns don skata finish, wi go build dem again.” But God wey dey lead heaven sojas ansa, “Make una go ribuild dem, but I go still skata dem and pipol go koll una kountry, ‘Di Land wey Wikedness Full’ and dem go koll una pipol, ‘Di pipol wey Oga God go always dey vex with.’ ”


Den my pipol go si di difren between good and bad and between doz wey dey serve mi and doz wey nor dey serve mi.”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ