Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Hosea 2:19 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

19 Israel, I go make yu my wife; I go love and dey faithful to yu; I go always sorry for yu and yu go bi my own forever.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Hosea 2:19
27 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Love wey nor dey fail and trut, don join togeda. Raitiousness and peace don kiss each oda.


Bikos God dey holy, E go save Jerusalem and anybody wey turn from sin kom meet am.


Na raitiousness go make una strong. Una go dey save from pipol wey dey opress una and from doz wey dey kause wahala.


Bikos di Pesin wey kreate una, go bi una husband. Na God wey get pawa bi en name. Israel God wey dey holy go save una. Dem dey koll am di God of di whole eart.


Israel pipol, una bi like yong wife wey sorrow full en heart, bikos en husband leave am.” But God dey koll una kom meet am sey,


den, na only my name una go take swear sey, ‘As long as God dey alive, wi go do wetin wi promise’, den all di nashons go praiz mi and I go bless dem bikos of una.”


“ ‘ “As I dey waka pass again, I kon si sey di time wey yu suppose to undastand wetin love mean, don rish. So, I kover yor naked body with my klot kon promise sey I go always love yu. Yes, I marry yu and yu kon bi my own.” ’ ” Dis na wetin God wey get pawa dey tok.


I go pour my Spirit put for Israel pipol body and I nor go leave dem again. Mi, God wey get pawa, don tok.”


So God ansa, “I go bring my pipol kom back to mi. I go love dem with all my heart and I nor go vex for dem again.


But pipol go full Judah land forever and Jerusalem land go dey from one generashon go rish anoda one.


For dat day, I go remove all di juju name from di land and nobody go remember dem again. I go kill anybody wey klaim sey en na profet, den pipol mind nor go dey to go woship or serve juju again.


Di pesin wey won marry new wife naim bi di bridegroom. En friend, wey bi di best man, dey listin to am. E go dey happy well-well wen e hear di bridegroom dey tok. Na dis dey make mi happy and my joy don full.


So my brodas and sistas, na so e bi with una too. Una don bikom part for Jesus Christ body and una don die to di law pawa. Naw, una dey free to bi Christ own; di pesin wey God raiz from deat make una for dey serve am.


I dey jealous for una with God jealousy, bikos I promise sey na one man una go marry. Like woman wey nor no man, na so I won give una to Christ.


And I si di holy town, di new Jerusalem, dey kom down from heaven from God and dem dress am like woman wey won go meet en husband.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ