King Jeroboam still dey do one feast for di fifteent day for evry eight mont, just like di feast for Judah. E make sakrifice for di gold melu on-top di altar wey e make for Bethel kon put priest for di woship place wey e build.
Listin to wetin mi, Israel God wey dey mighty, dey tok. “Dem nor go hear joy, happiness and marriage nois. Di pipol go dey alive to si all dis tins wen e dey happen.”
For Judah town and Jerusalem street, I go make sure sey nobody dey shaut or happy with joy sey pesin dey marry. Dis na bikos di whole land dey empty and dirty don full der.”
Dis tin show sey na so too Israel pipol go dey: dem nor go get king or leader; dem nor go do sakrifice or serve stone again and dem nor go get juju or image wey dem go use take konsult dia gods.
“For dat day, na kry and mourning nois go bi di song wey dem go dey sing for di palis. Dead body go dey evriwhere and evribody go kwayet as dem dey go beri dem.”
Una dey tell unasef sey, “Wen di new moon festival go end sef, so dat wi go fit go sell awa korn? Na wen Sabat go end, make wi for fit sell again? Wi nor fit wait to shit awa customers, use wayo take measure tins, so dat wi go get more money.