Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Hosea 2:10 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

10 I go naked am for en lovers front and nobody go fit save am from my pawa.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Hosea 2:10
19 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

(Atalaya wiked well-well and en sons break enter God Temple kon use all di tins wey dey der take woship Baal juju.)


All of una wey don forget mi, make una turn from sin kom meet mi or I go kill una finish and nobody go kom help una.


Make yu know sey God go ponish wiked pipol; but na betta judgement go follow raitious pipol.


But I go ponish dem, I go kut dia hair kon shave dia head to bololo.”


And wen una ask, “Wetin make all dis tins dey happen to us? Why dem tear awa klot komot from awa body kon trit us like ashawo? Na bikos of sin?” Yes! Na bikos una don sin.


Na only God go tear una klot komot for una body kon disgrace una.


Yu design di place where yu for dey woship yor juju with yor klot like sey na ashawo house and yu kon dey sleep with evribody for der.


I give yu food; di best flower, olive oil and honey, but yu sakrifice dem give di juju sey, Make yu protet mi.” Dis na wetin God wey get pawa dey tok.


Bikos dem hate yu, dem go take evritin wey yu don work for and yu nor go get anytin again; yu go dey naked like ashawo. Na yor yeye and ashawo life


Israel pipol bi like grape vine wey grape full. But di more dem dey prosper, di more dem dey build juju altars. Di more good-good tins dey happen for di town, di more dem dey make and woship juju.


Before-before, wen Efraim pipol dey tok, di oda tribes for Israel dey fear and respet dem. But naw, Efraim pipol dey woship Baal juju and dis tin kon distroy dem.


If e nor gri stop, I go naked am, just as e bi wen dem born am. I go make am bi like dry land, where nor-tin dey grow and I go let wota hongry am till e die.


Di priests dem bi like tif wey hide for bush bikos one attack pesin. Dem dey kill pipol for di road wey dem dey pass go Shekem and dem still dey do many wiked tins!


Doz wey remain for Israel go skata go oda nashons and dem go bi like lion among animals for bush; like yong lion wey dey mash and kill oda animals without who go save dem.


So, make una nor judge anybody until Christ go kom back. E go espose evritin wey dey darkness and di tins wey dey inside pesin heart. Dat time, na God go praiz evribody akordin to wetin dem do.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ