8 Efraim pipol nor go get anytin to do with juju again. I go ansa dia prayers kon kare for dem. I go give dem house like betta green fig tree and na mi go bless dem.”
I go make cedar, akacia, myrtle and olive trees grow for di desert. Forest wey pine, junipa and cypress trees dey, go grow for dry land where tree nor suppose grow.
Cypress trees go grow for where grass dey naw. Myrtle trees go grow for where shuku-shuku dey. Dis sign go dey forever and e go dey remind una about wetin mi wey bi God don do.”
Dem go bring pine wood, junipa, cypress and di wood wey fine pass for Lebanon forest kom take build Jerusalem again; so dat my temple go fine and di town go get glory.
and na on-top di mountin wey high pass for Israel. E go grow kon get branches; bear seed and e go bi very fine cedar. Difren birds go stay der kon build house put for di cedar tree.