But Yu dey si di trobol and wahala wey dem dey kause. Yu dey si evritin; so make Yu ponish dem. Doz wey nor get help dey trust Yu and na Yu dey fight for shidren wey nor get papa and mama.
God sey, “If una really obey di Oga una God kon do wetin good for my eyes and listin to my kommand, I nor go sofa una with all di diziz wey I send go Egypt, bikos na mi bi di Oga una God wey dey heal una.”
God sey, “All of una wey wota dey hongry, make una kom drink from dis wota! Una wey nor get money, make una kom chop! Make una kom drink wine and milk and una nor go pay anytin!
Den I ansa, “My God, even doh awa sins dey tok against us, make Yu kom save us bikos of di honor for yor name. True-true, wi don turn from Yu many times and sin against Yu.
So God ansa, “Israel, una bi my shidren wey I love well-well. I dey always tink of una with love wen ever I remember una name. Una dey for my heart and I go really sorry for una.
So just as lion dey attack oda animals for bush, na so too dia enemies go attack dem and just as wolf bi for desert, na so too dem go distroy dem. Na leopard go dey guide di town and if anybody won kom out from di town, dem go distroy am, bikos dia sin too many and dem don turn from God.
Den di nashons wey dey near der, wey survive, go know sey mi wey bi God don ribuild dis town wey skata before kon plant put for di field wey bin dey empty. Mi wey bi God don promise sey, I go do wetin I sey I go do.”
Di Oga yor God dey with yu and E dey always diliver yu. E dey happy well-well bikos of yu. En love nor go make yu fear again and E go dey sing sweet songs bikos of yu.’
“Finehas wey Eleazar born, wey bi Aaron di priest grand-pikin don remove my vexnashon from Israel pipol, wen e do dat tin wey e do and naim make mi nor distroy dem wen I dey vex.
Bikos God save and koll us to live holy life. E do like dis, nor bi sey wi deserve am bikos of wetin wi do, but na so E plan am even before di world start, so dat wey go know en grace thru Jesus Christ.