But wen David don kount di pipol finish, en heart kon dey judge am, den e tell God, “I don kommit big sin for dis tin wey I do! Abeg, make Yu forgive mi. Na foolish tin I do so.”
God sey make I go tell Israel pipol for nort sey, “Una wey nor dey faithful, make una kom back kom meet mi. I go sorry for una and I nor go vex again! I nor go vex for una forever.
Make di priest wey dey serve God for di altar, stand and kry for di temple gate kon sey, “My Oga God, make Yu sorry for yor pipol. Nor allow oda nashons hate, laf and ask us sey, ‘Where una God der?’ ”
Den di angel tell doz wey stand near am, “Make una pul di dirty klot wey dis man wear so, komot from en body.” Den e tell Joshua, “I don forgive yu all yor sins and naw, I go give yu new klot make yu wear.”
Wen day break, John si Jesus dey waka kom meet am, den John sey, “Make una look! Dis na di Sheep wey God send kom die, so dat God go forgive us awa sins.”
Bikos God save and koll us to live holy life. E do like dis, nor bi sey wi deserve am bikos of wetin wi do, but na so E plan am even before di world start, so dat wey go know en grace thru Jesus Christ.
So unasef too, don bi stone wey dey alive and God dey build una as en spiritual house, so dat una go bi priest wey dey holy and una go offa spiritual sakrifice wey E go asept thru Jesus Christ.
But if wi dey inside di lite as en ensef dey inside lite, all of us go bi en friend and Jesus wey bi en pikin, go use en blood take wosh all awa sins komot.