Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Hosea 14:1 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

1 Israel pipol, make una turn back kom meet di Oga una God, bikos una sin don make una fall.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Hosea 14:1
26 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Hazael kon ask am, “My oga, wetin make yu dey kry?” Elisha ansa, “Na bikos I know di kind trobol wey yu go kause for Israel pipol. Yu go burn dia propaty, kill dia yong men, distroy dia shidren and wimen wey get belle, yu go kut dia belle open.”


Even doh God go ponish Egypt pipol, E go still heal dem again. Dem go turn to am and E go hear dia prayer kon heal dem.


Na di wiked tins wey una do go ponish and kondemn una, bikos una turn from mi. So, una go learn as e betta and wiked rish nor to dey fear mi or forget mi wey bi di Oga una God.” Mi, wey bi God, don tok.


God sey, “Israel pipol, if una really wont turn back kom meet mi, make una distroy all una juju,


Awa crown don fall komot from awa head, bikos wi don sin and naw, wi dey sofa.


Yor senior sista na Samaria for nort. Yor yonga sista na Sodom for sout.


Tell dem sey, ‘God sey, “As long as mi wey get pawa dey alive, I nor dey happy to si doz wey dey sin, dey die. I prefer make dem stop to sin, so dat dem go get life wey nor dey end. So, Israel pipol, make una stop di wiked tins wey una dey do. Na wetin make una won kill unasef finish?” ’


Like dis too, I fit warn wiked pesin sey e go die, but if e stop di bad tins wey e dey do kon dey do wetin good and rite;


I sey, ‘Make una plant raitiousness for unasef, den una go harvest love wey nor dey end. Make una klear new groun for unasef, bikos dis na di time to turn kom meet mi, so dat I go save una.’


So, make una turn kom meet una God. Make una show love; dey judge well and dey patient as una dey wait for God.


Efraim pipol sey, “Wi get money well-well and nobody go fit akuse us sey wi use wayo take get awa money.”


Israel pipol, mi wey bi una only helpa go soon distroy una.


Bikos dem dey make money from my pipol sin, dem kon dey kommit more sin.


Israel pipol sturbones dey tok against dem. Dia sin dey make dem kick stone fall and Judah pipol dey fall with dem too.


Make una kom make wi turn go meet God! Na-im wound us, but E go heal us! Even doh E wound us, E go bandage awa sore.


Na for my present Israel pipol grow until dem kom fine like Tyre. But naw, only dem go use dia hand bring dia shidren out kon kill dem.


Di time to ponish Israel don rish; di time wey pipol go get wetin dem deserve. Dat time, Israel pipol go know wen e happen! Una sey, ‘Dis profet na fool. Dis man wey feel sey e know well-well, dey kraze!’ Una hate mi well-well, bikos una sin too many.


God sey, “Ammon pipol don too sin, but I go ponish dem naw, bikos dem dey fight to get more land and wimen wey get belle for Gilead, dem tear dia belle open.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ