Even wen dem get dia kingdom, dem nor gri serve Yu, doh Yu still show dem yor goodness. Yu give dem betta land to plant, yet dem nor gri turn from dia wikedness.
God ask, “Jerusalem pipol! Wetin nor go make mi ponish una wen e bi sey, una leave mi kon go woship gods wey nor bi god at-all? Even doh I dey give una evritin wey una wont, una still dey bihave like wife wey go sleep with who nor bi en husband and una dey stay with ashawo.
Israel pipol bi like grape vine wey grape full. But di more dem dey prosper, di more dem dey build juju altars. Di more good-good tins dey happen for di town, di more dem dey make and woship juju.
I go ponish am for all doz times wey e forget mi kon dey burn incense give Baal and dey run follow en lovers with all di gold wey e wear. Mi, wey bi God, don tok.
E go run follow en lovers, but e nor go fit katch dem. E go find dem, but e nor go si dem. Den e go sey, “I go-go back to my first husband. I betta well-well den wen I dey with am, pass as I dey naw.”
My pipol don die finish bikos dem nor know mi. Since di priests don rijet mi, misef go rijet dem as my priests. Since una don forget una Oga God laws, misef go forget to bless una shidren.
Dem nor dey pray give mi with all dia heart. Instead, dem dey pritend dey kry and take body nak dia bed, just as doz wey nor know God dey do. Anytime dem dey do di korn and wine ofrin, dem dey kut demsef like sinnas and dem nor gri do wetin I tok.
Israel pipol build royal palis, but dem don forget who kreate dem. Judah pipol don build many strong town, but I go send fire go burn dia palis and di towns rish groun.”