Even doh dis pipol dey make nois like heavy wave for sea, wen God shaut for dem, dem go turn run go one far land and na breeze go karry dem like leaf for hill or like dirty wey strong breeze blow.
Den all di iron, gold, silva and bronze kon bi like san-san for dry sizin. Breeze blow kon karry all of dem go and dem nor si dem again. But di stone wey skata di image, grow turn to mountin kon kover di eart.
But God tell dem, “Israel and Judah pipol, wetin I won take una do? Bikos di love wey una get for mi dey kwik disappear like dew for morning; like dew wey dey vanish wen day dey break.
Make una gada before judgement go start; before una time to turn from sin kom meet God go pass, just like wen breeze blow leaf trowey. Make una do di rite tin naw, before God vexnashon go fall on-top una and before en judgement go start.
Nobody go wahala dem wen dem dey plant dia seed. Dia vine go get many fruits; di groun go produce food and rain go always dey fall for dem. I go give all dis blessings to my pipol wey remain.