16 I go ponish Samaria pipol, bikos dem nor gri listin to mi. Dem go die for war; dia shidren go fall kon skata and dia wimen wey get belle, dem go tear dia belle open with swod.”
For dat time, Menahem from Tirzah attack Tifsah. E kill evribody wey dey di town and doz wey dey stay near di town, bikos dem nor gri surenda. Even wimen wey get belle for der, e kut dia belle open.
For nine years wen Hoshea dey rule, Assyria king katch Samaria kon karry Israel pipol go Assyria. E keep dem for Halah near Habor (Gozan river) and for Medes town.
Hazael kon ask am, “My oga, wetin make yu dey kry?” Elisha ansa, “Na bikos I know di kind trobol wey yu go kause for Israel pipol. Yu go burn dia propaty, kill dia yong men, distroy dia shidren and wimen wey get belle, yu go kut dia belle open.”
Nobody or town go defend Israel land again and na oda pipol go rule Damaskus. Pipol wey go survive for Siria, dem go disgrace dem like Israel pipol. Mi, wey bi God wey get pawa, don tok.”
Dem nor dey pray give mi with all dia heart. Instead, dem dey pritend dey kry and take body nak dia bed, just as doz wey nor know God dey do. Anytime dem dey do di korn and wine ofrin, dem dey kut demsef like sinnas and dem nor gri do wetin I tok.
God sey, “Ammon pipol don too sin, but I go ponish dem naw, bikos dem dey fight to get more land and wimen wey get belle for Gilead, dem tear dia belle open.
Go tell di pipol wey dey stay for Egypt and Ashdod palis sey, “Make una gada round di hills for Samaria! Make una si di wahala wey dey happen for di town and di bad-bad tins wey dem dey do.”
I si God stand near di altar kon sey: “Make yu nak di temple pilas for up, until di foundashon go shake. “Break dem make e fall for di pipol head. I go kill di remainin pipol for war and nobody go fit eskape.
Una dey obey only King Omri wiked laws and una wiked like King Ahab! So, I go use una as ezample kon distroy una finish. Dem go ponish una and evribody wey si una, go laf well-well.”
Yet, dem still karry en pipol go as slaves. Dem kill dia shidren for evriwhere for di street. Dem shain and divide Egypt sojas among demsef kon karry dem go as slave.