Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Hosea 13:14 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

14 I nor go save dis pipol from grave or save dem from deat pawa. So deat, make yu bring all yor wahala kom! Yu grave, make yu bring all yor distroshon kom, bikos I nor go pity for dis pipol again.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Hosea 13:14
32 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Bikos God don forgi-am, di angel go sey, ‘Release am! E nor go fit go join dead body. Si wetin dem take replace en sin, so e don dey free.’


En neck get strong pawa wey fit make evribody wey near am, fear.


Bikos God nor go leave my soul inside grave or allow en holy pikin rotin for der.


My God, Yu don bring mi kom out from grave. Yu keep mi, so dat I nor go fall inside pit where dead body dey.


But for mi, God go save my life. E go save mi from deat.


So make wi nor dey judge or vex bikos wiked pipol get money or get fine house.


Even doh Yu don make mi sofa well-well, I know sey Yu go make mi happy again kon take mi komot from di pit wey I dey.


bikos di love wey Yu get for mi, big well-well and Yu don save mi from deat.


God wey get pawa go distroy and swallow deat forever! Doz wey dey kry, God go klean dia eyes and E go remove di disgrace wey en pipol don sofa for dis world. God, wey dey lead heaven sojas, don tok.


God pipol wey don die, go kom back to life! Dia body go raiz-up again. So, all of una wey dey grave, make una wake-up kon shaut with happiness, bikos una go grow well like grass wey dew fall put and di eart go bring back evritin wey don die.”


Una don rijet and turn from mi and na dis make mi vex kon bring wahala for una. I don taya to dey sorry for una.”


Make di pesin bi like town wey God nor sorry for wen E dey distroy tins. Make e hear pipol dey kry with pain for morning and na war kry go full en ear for aftanoon.


God don promise Israel pipol sey, “E go give dem sun as lite for day time, while di moon and star go dey shine for nite. E sey, E go shake di sea and di wave go roll on-top each oda. En name na God wey dey mighty.”


God kon tell mi, “Man pikin, tok to di breeze. Tell di breeze sey God wey get pawa dey kommand am to kom from difren place kon give life to dis body dem wey dey groun, so dat dem go get life.”


Afta two or three days, E go heal us, so dat wi go fit stay for en present again.


Israel pipol sturbones dey work against dem. Even with evritin wey don happen, dem nor still gri turn from sin kom meet di Oga wey bi dia God.


“Na mi bi God and I nor dey shange. Una wey bi Jakob shidren, na mi make una neva die finish.


God nor bi like man wey dey lie and E nor bi human being wey dey shange en mind. Anytin wey E promise, E dey do am; Anytin wey E tok, na so e go bi.


Bikos wen God rijet Israel pipol, di whole world kon get salvashon. Na how e go kon bi, wen God asept dem back? E go give life to pipol wey won die.


God nor dey take back wetin e don already give pipol or shange en mind about di pipol wey E don choose.


Wi dey struggol as wi dey dis awa body. Wi dey karry heavy load, bikos wi nor won remove di klot wey bi awa body, but wi won wear heaven own join am, so dat life go swallow dis awa body wey fit die.


E go use en pawa wey make am Oga God for evritin, take shange dis awa ordinary body and awa body go kon bi like en own wey get glory.


Since wi bilive sey Jesus die and e wake-up; na so too wi bilive sey, doz wey bi Christian before dem die, God go raiz dem up.


bikos evry betta and pafet gift dey kom from God. E dey kom down from di Papa wey kreate lite and E nor dey shange.


And doz wey don die inside sea kon kom out. Deat and grave release di ones wey dey inside dem and God judge dem akordin to wetin dem do.


E go klean evry tears from dia eye and deat nor go dey again. To dey mourn, kry and pain nor go dey again, bikos di tins wey dey before, don vanish.”


So I look kon si one horse wey en kolour bi like green wey don dey fade! Di pesin wey dey ride am, na Deat dem dey koll am and en friend na di Grave. Wen dem divide di eart into four, dem give di two of dem pawa ova one part, so dat dem go kill pipol with dia swod; honga; diziz and wiked animals.


God wey get Israel must do wetin E tok and E nor dey shange en mind, bikos E nor bi human being wey dey shange mind.”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ