“Dis na wetin Hezekaya tok: ‘Today na bad day, bikos na curse and trobol full am. E just bi like wen woman wey get belle won born, but e nor get pawa to push di pikin out.
Dis na di message wey e send dem: “Today na trobol day, bikos dem don ponish and disgrace us well-well. Wi bi like woman wey won born, but wi too weak to even push.
Naw, make una tink am well! Man fit get belle kon born pikin? So wetin make una men dey put dia hand for belle like sey dem bi woman wey won born? Wetin make evribody dey fear?
I hear kry, like woman wey won born; shaut like woman wey dey born en first pikin. Jerusalem pipol dey find as dem go take breath and naw, dem dey kry sey, “Make una help us! Bikos na die wi dey so o-o!”
Wen woman won born pikin, e dey sofa strong pain, bikos en time to born don rish, but wen e don born, e go happy and e nor go remember di pain again, bikos e go si sey e don born pikin.
Fear katch Felix, as Paul dey tok about di Good News, sef kontrol and how God judgement go take kom, so e kon tell Paul, “Make yu go first, wen I get time, I go sey make dem bring yu kom again.”
Bikos E sey, “I hear una for di rite time and wen di day for Mi to save una rish, I help una.” Si, na di rite time bi dis; na naw bi di day for salvashon!
Wen pipol dey sey, “Evritin dey okay and peaceful,” na dat time wahala wey go skata evriwhere go kom and e go bi like di pain wey woman dey face wen e won born and nobody go eskape from am.