and dey borrow pipol money to make gain. E go fit live? No! E nor go live. E don do all dis bad tins, so e must die and e go blame ensef for en own deat.
Den e go attack and konker many nashons wey dey near di sea. But one ruler from anoda kountry go win am kon stop all di nonsense wey e dey do since. All di yeye tins wey Siria king don do, di ruler go do am to am too.
Dem nor dey keep di promise wey dem make. Instead, dem dey lie, kill, tif and sleep with oda pipol husband and wife. Na so-so wiked tins dem dey do and dem dey kill each oda evriday.
Dem dey always waka leave mi go meet and follow oda gods wey nor get pawa. Dem nor dey stabol; dem bi like bow wey bend. Bikos dia leaders dey tok anyhow, dia enemies go kill dem, den Egypt pipol go laf dem well-well.”
Una dey obey only King Omri wiked laws and una wiked like King Ahab! So, I go use una as ezample kon distroy una finish. Dem go ponish una and evribody wey si una, go laf well-well.”
“So, di Oga wey bi Israel God sey, ‘Aldo I tok sey yor house and yor grand-grand papa house go serve mi forever, but e nor go happen again! Bikos I go honor doz wey honor mi, but doz wey nor gri do wetin I tok, I go curse dem!