11 But Jabesh-Gilead pipol nor mean anytin bikos dem dey woship juju. And dem dey sakrifice animals for Gilgal; dia altars bi like stones wey dem gada togeda for field wey dem klear.
E get one profet, en name na Elijah and e kom from Tishbe for Gilead. E go tell King Ahab, “As long as di Oga wey bi Israel God (wey I dey serve) dey alive, dew or rain nor go fall for some years, unless I kommand sey, make rain fall.”
God really warn Israel and Judah pipol thru all en profets and doz wey dey si wetin go happen sey, “Make una turn from sin kon obey my kommand and laws wey dem rite for una. Na mi sey make una grand-grand papa dem keep dis law and I dey send my savants kon remind una about am.”
“E don tey wen una rijet my kommand or obey and woship mi. Instead, una give unasef to all di gods wey dey di hill and under evry green tree, like sey una bi ashawo wey dey find who e go sleep with.
Where di gods wey una make for unasef? Wen ever una dey for trobol, make dem kom save una if dem fit! True-true, di gods wey dey Judah many like di towns wey dem get.
Israel pipol bi like grape vine wey grape full. But di more dem dey prosper, di more dem dey build juju altars. Di more good-good tins dey happen for di town, di more dem dey make and woship juju.
But even doh Israel pipol nor dey faithful to mi, make una, Judah pipol nor bihave like dem. Make una nor go woship for Gilgal or Bethel or use God name take make promise for der.
So God sey, “All di bad tins wey dem dey do, na Gilgal dem from start am and na from der I start to hate dem kom. I go drive dem komot from my land, bikos of di evil wey dem do. I nor go love dem again. Yes! Even dia leaders don go against mi.
God sey, “Afta una, Israel pipol don go Bethel go sin for di holy place and woship juju for Gilgal, una go kon sakrifice animals for morning, den for evry three days, una go bring one out of evry ten tins wey una get kom.
Make una nor go Beersheba go woship. Make una nor find mi go Bethel, bikos Bethel nor mean anytin again. Make una nor go Gilgal, bikos dem go soon karry en pipol as slave go anoda land and Bethel go turn empty land.”