Even if Yu sorry for wiked pipol, dem nor go still learn how to do wetin dey rite and even for where raitious pipol dey rule, wiked pipol still dey do wiked tins; dem nor dey si God glory wey dey kom.
Den I ansa, “My God, even doh awa sins dey tok against us, make Yu kom save us bikos of di honor for yor name. True-true, wi don turn from Yu many times and sin against Yu.
Na di wiked tins wey una do go ponish and kondemn una, bikos una turn from mi. So, una go learn as e betta and wiked rish nor to dey fear mi or forget mi wey bi di Oga una God.” Mi, wey bi God, don tok.
Dem dey always waka leave mi go meet and follow oda gods wey nor get pawa. Dem nor dey stabol; dem bi like bow wey bend. Bikos dia leaders dey tok anyhow, dia enemies go kill dem, den Egypt pipol go laf dem well-well.”