Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Hosea 11:2 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

2 But di more I dey koll am, di more e dey waka far from mi kon dey do sakrifice and burn incense give juju.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Hosea 11:2
28 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

And for evry fifteent day for di eight mont; di day wey en ensef choose; e dey go di altar for Bethel go do sakrifice to celebrate di feast, wey e dey do for Israel pipol.


Naw, send message go gada Israel pipol kom meet mi for Mount Karmel with Baal 450 profets and Asherah juju 400 profets wey Jezebel dey support.”


Bikos of yor love, Yu dey patient with dem for many years. Yu send yor Spirit wey warn dem thru di profets. But yet, dem nor gri listin! So Yu allow oda nashons attack dem again.


for dia sins and dia grand-grand papa own. Dem don burn incense for juju hills kon tok bad tins about mi. So I go ponish dem for wetin dem don do pass.”


But my pipol don forget mi, dem dey burn incense give juju and na dis make dem fall komot for di way wey dem suppose follow. Dem nor dey follow di road wey I show dem, instead dem dey follow di road wey nor smooth at-all.


sey make I go tell Jerusalem and Judah pipol sey, “Mi wey bi God, dey ask una wetin make una nor gri listin to mi kon obey evritin wey I kommand.


but dem nor gri listin or hear mi. Dem still dey offa sakrifice give oda gods.


Dem don gri sey dem nor go turn kom meet mi. Dem koll mi wey bi di Most High God, but I nor go raiz dem up at-all.


I go ponish am for all doz times wey e forget mi kon dey burn incense give Baal and dey run follow en lovers with all di gold wey e wear. Mi, wey bi God, don tok.


Dem dey offa sakrifice on-top mountin kon burn incense for di hills and under evry tall tree, bikos dem dey enjoy di shade! Bikos of dis, una dotas dey do ashawo and una dota in-law dey sleep with oda pipol husband.


Bikos of di juju wey Efraim pipol dey serve, curse dey dia head. So make una nor go near dem!


Make una nor bi like una grand-grand papa dem. Before-before, my profets prish give dem sey, make dem stop to sin and do evil, but dem nor gri listin or obey dem.


“But dem nor gri listin, instead dem klose dia ear make dem for nor hear anytin.


“Jerusalem pipol! Jerusalem pipol! Una wey kill profets and stone pipol wey God send kom meet una! E don tey wey I won gada una shidren as fawol dey gada en pikin under en feada, but una nor gri!


Na dis bi di rizin why God go judge di world, bikos lite don kom inside di world, but pipol like to stay for darkness instead of lite, bikos dem dey do tins wey nor good.


“Si how una sturbon! Just as una grand-grand papa dem bi, na so una still bi too, bikos una don make una heart strong to disobey God!


Israel pipol sin against God, bikos dem kon dey woship Baal, Ashtoret and Siria, Sidon, Moab, Ammon and Filistia pipol gods. Dem forget God kon stop to woship am.


Dem forget God kon dey serve Baal and Ashtoret image.


Israel pipol forget di Oga dia God; dem sin against am kon bigin serve Baal and Asherah juju.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ