Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Hosea 10:6 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

6 Dem go give di juju as gift to Assyria king. Dem go disgrace and make Israel pipol shame, bikos dem go follow juju.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Hosea 10:6
22 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

King Shalmanesa for Assyria treaten am; so Hoshea kon bi en savant and e dey pay tax to am.


Dem dey waka well before, but naw, dem go dey stagga; na dia own advise go distroy dem.


Una go shame for unasef, bikos una woship trees kon build some juju gardin.


But na shame una go get from Fero proteshon, bikos Egypt pipol nor go fit help una at-all.


Pipol wey dey make juju, go shame and disgrace go follow dem. All of dem go waka go with disgrace.


Den, just as Israel pipol shame for dia god for Bethel, na so too Moab pipol go shame for Kemosh wey bi dia god.


But dem nor gri listin or hear mi. Dem dey do wetin dia sturbon and wiked heart sey make dem do. Instead make dem dey betta, dem kon worse pass as dem bi before.


Bikos nor-tin dey rish yu, yu kon dey follow Assyria pipol. Even doh yu bi dia ashawo, dem nor still dey okay for yu.


Wen una remember di wiked and wrong tins wey una do before, una go hate unasef, bikos of una sins.


E go karry dia juju and all dia betta tins with silva and gold go back to Egypt. Afta many years wey peace don dey,


So, breeze go karry dem go and dem go shame sey dem dey offa sakrifice give juju.”


As di priests dey plenty, na so dia sin against mi, dey plenty too. So I go turn dia honor to disgrace.


Wen Israel si as e dey sick and Judah si as e sore big rish, dem kon go meet Assyria great king make e kom help dem, but e nor fit cure or heal dia wound.


Na una Israel pipol karve di juju by unasef. Di juju nor bi god! Di gold melu wey una dey woship for Samaria, go skata to pieces!


Una dey obey only King Omri wiked laws and una wiked like King Ahab! So, I go use una as ezample kon distroy una finish. Dem go ponish una and evribody wey si una, go laf well-well.”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ