Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Hosea 10:5 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

5 So, Samaria pipol go mourn for di juju wey Bet-Aven pipol. Dem go kry, bikos dem go take di juju from dem kon karry am go anoda land.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Hosea 10:5
20 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

But Jehu kon dey sin like Jeroboam, Nebat pikin, wey make Israel sin as dem dey woship di juju wey dey Bethel and Dan.


Dem nor gri follow di Oga dia God kommand, instead dem make two juju iron and one Asherah juju kon dey bow down to stars for sky and dey woship Baal juju.


E kill all di priest wey nor know God wey Judah kings bin choose sey na dem go dey offa sakrifice for di high place for di towns for Judah and di arias around Jerusalem. (Dem dey offa sakrifice to Baal, di sun and moon; to di planets and all di stars for di sky.)


King Jeroboam appoint en own priest dem to dey serve for di woship place and for di juju altar wey e make.


“Naw, yu won fight against di royal pawa wey God give David shidren-shidren. Yu fit get plenty sojas and yu karry gold juju as yor god.


Di juju wey stand before don fall; dem nor fit save diasef and dem don karry di juju dem go as slave!


Dem still dey sin and woship juju wey dem make kon design am with silva. Dem dey sey, “Make una kom sakrifice and kiss dis juju!”


But even doh Israel pipol nor dey faithful to mi, make una, Judah pipol nor bihave like dem. Make una nor go woship for Gilgal or Bethel or use God name take make promise for der.


“Make una blow di war trumpet for Gibeah! Make una blow di wiso for Rama! Make una blow di trumpet for Bet-Aven! Benjamin pipol make una shake with fear!


“Israel pipol, make una stop to celebrate una festival like doz wey nor know God. Una don turn from una God and nor dey faithful to am again. Una don sell unasef give juju like ashawo wey dey di land and una love wetin una tink sey love una.


Efraim greatness go fly komot like bird and dem nor go born shidren. Dia wimen nor go get belle at-all.


‘For di day wen I go ponish Israel pipol for dia sin, I go distroy Bethel altars. I go break and skata evry altar for der too.


Na with my hand I go take skata Judah, Jerusalem and evritin wey koncern di Baal juju wey dem dey woship. I go distroy all dia wiked priests and nobody go remember dem again,


So, if wi nor do sometin, awa business go spoil and nor bi only dat one, but pipol nor go respet di temple wey awa juju, Artemis, dey stay again and dis woman wey di whole Asia dey woship, nor go get pawa again.”


Joshua send men from Jeriko sey make dem go spy Ai town (Ai town dey near Bet-Aven, di east side for Bethel land) e kon tell dem, “Make una go spy di land.” So di men kon go spy di town.


Mikah ansa, “Wetin una mean by, ‘Wetin happen?’ Una don take all di gods wey I make and my priest dey go, wetin remain for mi naw!”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ