Di pawa rod nor go komot from Judah and di pawa to take rule, go always dey en leg, until e go rish di pesin wey really get am and evribody go obey yu.
Dis tin show sey na so too Israel pipol go dey: dem nor go get king or leader; dem nor go do sakrifice or serve stone again and dem nor go get juju or image wey dem go use take konsult dia gods.
But naw, wetin make una dey shaut and kry? Una nor get king to lead una? Abi dem don kill una wise men finish? So wetin make una dey feel pain like woman wey won born?
Den, dem kon bigin dey shaut, “Kill-am trowey! Kill-am trowey! Make yu kill-am!” Pilate kon ask dem, “Una wont make I nail una king for cross?” Di High Priest dem kon sey, “Di only king wey wi get na Caesar.”