14 war go kom meet una and all una strong house go skata. Dat day go bi like wen King Shalman fight and distroy Bet-Arbel town kon kill both mama and dia shidren.
Dem nor gri follow di Oga dia God kommand, instead dem make two juju iron and one Asherah juju kon dey bow down to stars for sky and dey woship Baal juju.
Nobody or town go defend Israel land again and na oda pipol go rule Damaskus. Pipol wey go survive for Siria, dem go disgrace dem like Israel pipol. Mi, wey bi God wey get pawa, don tok.”
E go skata dem like pot wey fall press each oda kon break. Na so too shidren go bi to dia papa and mama. I nor go pity or sorry for dem. I must distroy dem and nor-tin go fit stop mi.”
I go ponish Samaria pipol, bikos dem nor gri listin to mi. Dem go die for war; dia shidren go fall kon skata and dia wimen wey get belle, dem go tear dia belle open with swod.”
Yet, dem still karry en pipol go as slaves. Dem kill dia shidren for evriwhere for di street. Dem shain and divide Egypt sojas among demsef kon karry dem go as slave.