Afta e don tink am well-well, e make two melu image with gold kon tell en pipol, “Israel pipol, e don tey wen una dey go woship for Jerusalem. Naw, make una si di god wey bring una kom out from Egypt!”
“But for naw, mi, wey bi God, dey sey: ‘I dey send enemies wey go katch dis pipol like man wey dey katch fish. Afta, I go send oda pipol wey go katch dem like huntas for mountins, hills and holes for rock.
Bikos of dis, I go bring all di pipol wey yu love togeda; di ones wey yu like and doz wey yu hate. Dem go round yu like circol, den I go tear yor klot komot yor body kon let dem si yor nakednes.
So my vexnashon go end and my ponishment go rest for dia head, den I go dey okay. Wen all dis tins don happen, una go si, undastand and know sey na mi God, tok to una.
Oga God sey, “Israel pipol, na since una dey Gibeah una dey sin kom rish naw and una nor dey progress at-all. Una nor si as dem kill Gibeah wiked pipol for war?
Just as e sweet God to prosper and make una plenty, na so too God go dey happy to distroy una. “E go remove una from di land wey una won enter go stay,