Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Hosea 1:9 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

9 So God tell Hosea, “Make yu koll dis one, ‘Nor bi my pipol (Lo-Ammi),’ bikos Israel pipol nor bi my pipol and I nor bi dia God.”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Hosea 1:9
5 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Den God tell mi, “Even if Moses and Samuel stand here dey beg for dis pipol, I nor go listin or sorry for dem. So make yu take dem komot for my front kon tell dem make dem dey go!


But di next day, afta Pashhur don release mi, I kon tell am, “God nor koll yu Pashhur, but di name wey E give yu na, ‘Fear Dey Evriwhere.’


But di time dey kom wen Israel pipol go plenty like san-san for sea wey nobody fit kount or measure. Aldo God dey sey, “Una nor bi my pipol,” but di day dey kom wen God go sey, “God wey nor dey die, na-im bi una papa!”


Afta Gomer don stop to breast feed Lo-Ruhamah, e kon get belle again and e born anoda boy.


I go make my pipol stay for di land and dem go prosper. Doz wey dem dey koll “No-pity” before, I go pity for dem and doz wey dem dey koll “Nor bi my pipol,” I go sey, “Naw, una don bi my pipol”, den dem go ansa sey, “Na Yu bi awa God.”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ