Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Hosea 1:11 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

11 Den Judah and Israel pipol go kom togeda as one again. Dem go choose one pesin wey go lead dem and dem go plenty kon prosper for dia land again. Yes! Dat day for Jezrel, go dey great well-well!

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Hosea 1:11
24 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Wen yu go war, yor pipol go dey happy to follow yu go fight. Na holy garment dem wear for yor body and yor pawa go dey fresh evriday like morning dew.


Dia leaders go kom from dia own nashon and dia prince go bi dia own pipol. E go kom meet mi wen I invite am, bikos nobody go fit kom wen dem nor invite am.


bikos time dey kom wen I go bring my pipol, Israel and Judah kom back to di land wey I give dia grand-grand papa and e go bi dia own again. Mi, wey bi God, don tok.”


Di day wen una go face sirious wahala dey kom and dem nor go fit kompare am with any oda day. Even doh di wahala go too mush for my pipol, dem go survive am.”


Afta I don bring Israel pipol kom back to dia land, dis na di new kovenant wey I go make with dem: I go put and rite my law for dia heart. I go bi dia God and dem go bi my pipol.


“I go gada all my pipol from di kountry where I skata dem put, bikos I bin dey vex and I go bring dem back to dis land, so dat dem go dey save.


I go take Israel pipol go back to dia land. Dem go chop from Mount Karmel and Bashan. Dem go chop beleful for Efraim hill and Gilead land.


God wey get pawa sey, “But naw, I go sorry for Jakob shidren wey bi Israel pipol kon make dem prosper again. Yes! I go guide my holy name.


Den make yu go koll yor brodas, “Ammi” (wey mean “My pipol”)! And yor sistas, “Ruhamah” (wey mean “Pity”)!


But di time dey kom wen Israel pipol go turn kom meet Oga God and one among David shidren-shidren, go bi dia king. Den dem go fear God and E go bless dem.


Bikos wen God rijet Israel pipol, di whole world kon get salvashon. Na how e go kon bi, wen God asept dem back? E go give life to pipol wey won die.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ