Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Hibru 9:3 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

3 Anoda room wey dem rite, “Holy of Holies”, dey for di curtain back.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Hibru 9:3
15 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Di room for inside wey dem dey koll, “Most Holy Place” na di temple back dem build am put. E long rish 30 fit and dem use cedar board take divide am from groun go rish di ceiling.


Den di priest karry di Kovenant Box enter di temple kon put am for di Most Holy Place; under di creatures wey get feadas.


Na violet, purpol, crimson and white klot, Solomon take make di curtain kon design and dekorate am with tins wey bi like angels.


E take di box enter di Tabanako; hang di curtain wey dey protet am kon kover di Testimony Box, just as God kommand.


Yu go put di Testimony Box inside kon kover di box with curtain.


Na for dis mountin God go for swallow sorrow, pain and evry bad tin wey dey trobol en pipol.


E measure di room and na thirty-five fit e bi. Dis room dey afta di room for centre. Den e kon tell mi, “Dis na di Most Holy Place.”


Wen time don rish for di pipol to travel, Aaron and en sons must enter di tent kon take di curtain take kover di Kovenant Box.


At wons, di temple kotton tear from up go rish bottom. Di groun bigin shake and rocks kon skata for evriwhere.


Dis hope strong for awa heart like ship wey dem tie make e nor for move, bikos di hope wey wi get dey kamkpe and strong gidigba. Di promise go take us pass di curtain for heaven, until wi rish where God dey;


But na only di High Priest dey enter di Holy Place wons a year. For der, e go first offa blood for en sins, before e go offa for di pipol own, bikos dem nor know wetin dem suppose to know.


Di Holy Spirit kon esplain sey, “Di way to rish di Holy Place neva open as long as di old tent still dey.”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ