24 Christ nor enter di Holy Place wey human being build like di original building for heaven, but na heaven e enter and naw, e stand for God present for awa sake.
God klimb go where high well-well. E don katch and put many pipol for prison. Even men wey sin well-well dey praiz Yu. True-true, di Oga awa God dey stay for der!
Make yu put di two stones for di priest garment shoulder, so dat e go stand for Israel sons and Aaron go karry dia name go meet God, just to dey always remind am about dem.
Wi know sey if dis awa house for eart, wey bi awa body skata, God get di one wey wi go stay, wey e bi sey nor bi human being hand build am and e go last forever for heaven.
Na dis pikin bi God image and e dey show God glory. Naim dey keep evritin wey dey dis world with en pawa. Afta e don die make God for forgive evribody dia sins, e kon go sidan for God rite side for heaven.
Make wi dey look Jesus Christ wey give us awa faith and go help us keep am. Bikos of di joy wey Jesus dey espect, e sofa for cross and nor mind di shame wey follow am. But naw, e don sidan for di rite hand side for God throne.
Di priest work for di temple bi like wetin dey happen for heaven. Bikos wen Moses dey one build God house, God tell am: “Make sure sey evritin bi like di design wey I show yu on-top di mountin.”
Na dis make dem dey klean di Holy Place for dis eart with animal blood, bikos e bi like di one for heaven. But di tins wey dey for heaven, nid sakrifice wey betta pass dat one.
Den anoda angel whole gold plate for hand kon stand near di altar. And God sey make e mix many incense join God pipol prayers and e go bi ofrin before di gold altar.