Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Hibru 9:19 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

19 Wen Moses read all di kommand give Israel pipol, e take goat and ram blood with wota and soap, kon sprinkol di blood on-top di Law Book and all di pipol body, den e sey,

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Hibru 9:19
26 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

So make Yu klean mi from my sins and I go dey klean; make Yu wosh mi and I go white pass snow.


Make una deep di plant wey dem dey koll hyssop inside di blood, den take di blood rub di two pole for di door and di one wey cross dem for up. And make anybody nor komot from inside en house until morning.


But naw, many nashons go happy for am and kings nor go fit tok anytin. Dem go si and undastand di tins wey dem neva hear before.”


I go pour klean and good wota for una body, so dat una go dey klean from di juju wey una dey woship before and evritin wey make una dirty.


“ ‘If di man dey give one sheep or goat, e must bi man own wey dey okay.


“ ‘Dem fit use sheep or goat take do peace ofrin, weda na man or woman, but e must dey okay.


Den e go bring hyssop leaf, deep am for wota kon sprinkol am for di tent, evritin for inside; for di pipol wey dey der and for di pesin wey tosh dead body, pesin bone or grave.


Den di priest go take cedar wood, hyssop leaf and one red rope kon put dem for fire.


Dem remove en klot kon wear am klot wey make am bi like king.


Dem wear am purpol klot kon take shuku-shuku make crown wear for en head.


Wen dem don laf am finish, dem pul di purpol klot komot from en body kon wear am en own klot. Den, dem kon go kill-am.


Den di sojas go kut tree branches wey get shuku-shuku make crown put for en head and dem kon wear am klot wey dear well-well.


So Jesus kom outside, with di shuku-shuku crown for en head and di fine klot wey dem gi-am wear. Den Pilate kon sey, “Na di man bi dis!”


Before-before, God tok to awa grand-grand papa dem for many ways, thru di profets,


So make wi draw near God with betta heart and strong faith, bikos God don wosh awa heart and body with klean wota.


since melu and goat blood nor fit really klean pesin from all en sins.


Una don kom meet Jesus, di pesin wey God use take start di new kovenant with en pipol and una don kom meet di blood wey dem spray and dis blood dey tok betta word wey pass Abel own.


Na wons Jesus enter di place wey holy pass. E nor enter with goat or ram blood, but na with en own blood, so e don save us forever and ever.


If goat or ram blood and ashes fit klean pesin akordin to di old tradishon,


Na dis make di first kovenant nor get pawa to save pipol, unless dem sakrifice blood.


make dem dey holy thru en Spirit. Make una dey obey Christ for evritin and en blood go klean una. Make grace and peace bi una own!


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ