17 Bikos pesin will nor dey mean anytin wen e still dey alive; e only dey yuzful wen di pesin don die.
Den Israel tell Josef, “Na die I dey so, but God go dey with yu and e go take yu go back to yor papa land.
Make una mind rest, bikos na my peace I give una. My peace difren from di one wey di world dey give. Make una nor fear or allow anytin worry una mind.
My brodas and sistas, make I use wetin dey happen evriday for life take make ezample for una: Wen pipol don make agriment, nobody go fit trow di agriment for korna or add anytin join am.
Dis kind agriment bi like pesin will. Di pesin must die first, before dem go fit use di will.
Na dis make di first kovenant nor get pawa to save pipol, unless dem sakrifice blood.