Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Hibru 9:11 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

11 So Christ don bi High Priest for di good tins wey don kom. E don enter di Holy Place for heaven wey dey pafet. Nor bi human being make di place and e nor dey among tins wey God kreate for dis world.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Hibru 9:11
30 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Di pawa rod nor go komot from Judah and di pawa to take rule, go always dey en leg, until e go rish di pesin wey really get am and evribody go obey yu.


Den I sey, “Look, I don kom, just as dem rite about mi for yor Book sey:


God dey tell en pipol sey, “I go kom Jerusalem kon defend and save all of una wey turn from una sin kom meet mi.


I go forgive dem dia sin. Yes! I go forgive dem all di sin wey make dem go against my kommand.


“Si! I dey send my messenja kom and e go prepare di way for mi. Den Oga God wey una dey find, go kom en temple at wons.


“Na yu bi di Mezaya wey wi dey espect or make wi wait for anoda pesin?”


“ ‘Betlehem pipol, una wey small pass for all di pipol wey dey rule Judah, na from among una di pesin wey go lead all my pipol for Israel, go from kom.’ ”


“Wi hear wen e sey, ‘I go distroy dis Temple wey dem build with hand and afta three days, I go build anoda one wey dem nor use hand build.’ ”


Den di Word kon shange to pesin and e stay with us for dis world. Wi si en glory wey show sey, naim bi di only pikin wey get korrect favor and trut, wey God send kom meet us.


Di woman ansa, “I know sey di Mezaya (di one wey dem dey koll Christ), wey go save evribody, go kom and anytime wen e kom, e go tell us evritin.”


Wi know sey God nor dey stay for house wey human being build, just as di profet tok,


Wi nor dey look for wetin eye fit si, but na wetin eye nor fit si. Bikos wetin eye fit si nor go last, but di tins wey eye nor fit si, dey last forever.


Wi know sey if dis awa house for eart, wey bi awa body skata, God get di one wey wi go stay, wey e bi sey nor bi human being hand build am and e go last forever for heaven.


Dem sekonsaiz una inside am. Dis nor bi human being sekonsishon, but na di spirit own wey Christ dey do.


Moses Law bi like shadow wey dey show good tins wey dey kom. Di shadow nor bi di tins, bikos di sakrifice wey dem dey offa evry year nor fit forgive pipol dia sins.


Dis mean sey di tins for eart go shake komot and na only di tins wey God nor won shake, go remain.


Bikos for here, wi nor get any town wey go last, but wi dey wait di town wey go kom.


So God make Christ like us wey bi en brodas and sistas. Like dis, Christ go sorry for us kon bi awa good High Priest. And bikos Christ dey koncern about God matter, e sakrifice ensef to remove awa sins.


My brodas and sistas wey God choose, make una tink about dis Jesus wey God send kom and na-im bi di High Priest wey wi bilive.


Dis awa High Priest undastand us wen wi dey weak, bikos all dis temptashon wey wi dey face so, e face dem too, but e nor sin.


Melkizedek wey bi “Salem king” and “God priest”, na-im bless Abraham, afta Abraham don win di kings for war.


Wi know sey God Pikin don kom and e don give us sense to know di trut about God. And wi dey inside en Pikin Jesus Christ. Na-im bi di real God and na-im bi di life wey nor go end.


Bikos pipol wey dey deceive odas, don enter di world; dem nor gri sey Jesus Christ don kom dis world as human being before. Dis kind pipol dey deceive odas and na anti-Christ dem bi!


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ