Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Hibru 9:10 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

10 To chop, drink and to do serimony take klean pesin body, na-im koncern dem. All dis one na rule for dis world, until di time wen God go bring di new law.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Hibru 9:10
32 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

“Yu go bring Aaron and en sons near di door-mot for di tent where dem for dey do meetin kon wosh dem with wota.


“Yu go bring Aaron and en sons kom di door-mot for di tent where dem for dey do meetin kon wosh dem with wota.


But I ansa, “God wey get pawa well-well, make Yu nor do am like dat! Since I small, I neva chop food wey di law dey forbid or chop animal wey die on en own or wey wiked animal kill. I neva chop any food wey nor klean.”


If e wosh di klot and di spot dem komot, e go wosh am again and e go dey klean.”


E must baf for di holy place kon wear en own klot. Afta dat, e go komot go give di burnt ofrin for en and di pipol sin.


Before Aaron go enter di place wey holy pass, e must baf and wear di garment wey priests dey wear; wey bi linen robe and short nika, both di belt and di priest kap.


go dey unklean till evening. E nor go fit chop anytin among di holy ofrin, escept e first go baf.


e must nor drink wine, strong drink or vinegar wey dem make from wine or strong drink; e nor go drink any juice wey dem make with grape and make e nor chop any grape weda na fresh or dry one.


And wen dem kom back from market, dem nor dey chop unless dem first wosh dia hand. Dem still dey follow many oda tradishons, like to wosh cup, kettol and chair wey dem dey sidan put chop.)


But naw wey una don know am (or abi make I sey God don know una), why una still dey follow all dis weak and yeye pawas? Una won bi dia slave again?


God go komplete en plan wen di time don rish, den E go gada evritin wey dey heaven and eart togeda under Christ, wey bi di head.


E don kansol Jew pipol law with all en kommand and rules, so dat e go fit make Jew and Gentile pipol to bi one with am and like dis, peace go dey among dem.


Di eldas for dat town must wosh dia hand on-top di small melu wey dem don break en neck.


Wen evening don rish, make e wosh ensef with wota, den wen sun don go down, e fit enter di kamp again.


So make una nor let anybody take food, drink, party, new moon or Sabat Day matter, take judge una.


So make wi draw near God with betta heart and strong faith, bikos God don wosh awa heart and body with klean wota.


Make una nor let difren-difren prishin wey una nor know turn una head. Una spiritual pawa dey kom from God grace, nor bi from food wey dem sakrifice, bikos di sakrifice nor fit help pipol wey dey do am.


God nor sey make en angels kontrol di world wey dey kom and wey wi dey tok about so.


wetin baptizim mean; to put hand for pipol head; to wake pipol from deat and about God final judgement.


don taste God good work and di betta wey dey kom,


Since dem don shange di rule to selet priest, di law must shange too.


E nor selet dat pesin bikos of en grand-grand papa dem, but na bikos en life nor go ever end.


Di first kovenant show how pipol go woship God for dis world.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ